July 27, 2024

AKA shooting: South African rapper Kiernan Jarryd Forbes family confam im tragic death

0

Di family of South African rapper Kiernan Jarryd Forbes, wey pipo sabi as AKA don confam im death inside one tragic shooting on Friday night.

Dem confam hours afta reports and news about im death begin trend. 

Inside statement dem release, dem say dem dey wait for further details from di police on wetin happun.

“To us, Kiernan Jarryd Forbes na son, brother, grandson, nephew, cousin and friend, most importantly father to im beloved daughter Kairo.

Police tok how AKA die

Meanwhile police confam say two unknown gunmen shoot and kill one popular musician wey be 35 years old and im security detail as dem dey comot one restaurant on Friday night.

KwaZulu-Natal police tok-tok pesi Robert Netshiunda confam to News24 say unknown gunmen gun down a “well-known rapper” for Florida Road, Durban on Friday evening just afta 22:00.

“I can confam say two men dey killed and one of dem na well-known rapper. Police no go release any names of di victims yet until we complete a full investigation” Netshiunda bin tok.

AKA suppose perform for di city on Friday night before di shooting.

AKA tragic death dey come about two years afta di tragic death of im fiancee Anele Tembe.

Reports say she die on 11 April, 2021 afta she fall from di 10th floor of one Cape Town hotel.

She and AKA bin dey visit Cape Town wen di incident happun. 

Reactions to AKA death

RIP AKA na top trend not just for South Africa but for Nigeria.

Member of South African parliament wey be one of di pipo wey react call out goment for failing to protect citizens.

While odas dey post im songs to remember am.

Who be AKA?

AKA wey im real name na Kiernan Jarryd Forbes na popular award winning South African rapper wey pipo sabi beyond di continent.

Dem born am for Cape Town for South Africa for January 28, 1988. 

Forbes also get oda nicknames like Supa Mega and King .

Forbes become popular afta releasing im single “Victory Lap” from im debut studio album, Altar Ego for 2010. Since den, e don go on to release oda songs wey bang like, All Eyes on Me for 2014, Fela in Versace for 2018 and Lemons for 2022.

AKA get one daughter, Kairo Forbes with im former partner, DJ Zinhle.

About The Author

Leave a Reply

Your email address will not be published. Required fields are marked *